As vice presido dun waka enter Kaduna state to greet people wey catch suffer head during the mistake bomb wey Nigerian army been thruway for one village for the state, senator Abdul’aziz Yar’Adua dun describe the matter as mistake wey no reach for Chief of Army Staff to step down.

Senator Abdul’aziz Yar’Adua talk this one wen him been dey relate with tatafo people and ay him wan commend the Chief of Army Staff (COAS), Lieutenant General Taoreed Lagbaja say im fit admit say the level na mistake and im dun take steps to fit re-arrange the matter and see how the army men fit take improve their movement and operations.

 

The senator add say make northern Elders Forum try calm down on the matter and say make dem leave the matter of say make Lieutenant General Taoreed Lagbaja comot from office but say make dem focus on how to take make people wey catch the suffer head feel better.

Vice presido Kashim Shettima with the governor of the state Uba Sani dun talk say dem go offer the people wey suffer for the matter with correct support wey go relieve their body and soul plus comfort.

 

The bombing wey be mistake from the Nigerian army wey happen on Sunday been dun kill reach 85 people with plenty other people wey catch wounjur for body inside Tudun Biri village for Igabi Local Government Area of Kaduna State.